Iya Basira lyrics by Styl-Plus with meaning. Iya Basira explained, official 2024 song lyrics | LyricsMode.com
Request & respond explanations
  • Don't understand the meaning of the song?
  • Highlight lyrics and request an explanation.
  • Click on highlighted lyrics to explain.
Styl-Plus – Iya Basira lyrics
This na one buka wey I dey like to go.
The food sweet sote e go make your mind blow, day and night iya bas how she do am I no know.
They think say na jazz, my broad no be so.

Chorus:
People people make una come o
Iya basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my moda or my girlfriends place
People People make una come o
Iya basira e go kill me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop again my moda or my girlfriends food.

Long throat na food go kill you-no be so, I say na food go kill you - oga mi no be so.

Wettin dey be say e get one day wey I say I go play go see my paddy Sunday,
Na so I reach there but Sunday e don high on beer luckily for me him junior broad eye e clear,
He say make we stroll to the area, little did I knw that I was strolling to my burial.
Right there were oshodi bus dey load was a little buka close to the mainroad.
I laf when e pass the door, e tell me say hin name na Iya bas for short but I bow when e order,
Iwesiatewa, ero mm purewater not even mineral. I come gree say I go manage to chop am
Before I realize I dey order 2nd round, 3rd round, 4th round, I never still stop
Wetting iya basira e give me chop?
Repeat chorus.

Long throat, na food go kill you, na food go kill you.

Oga mi, you think say na play when I say na the way wey I dey, e no day ok
Wetting be your own advice, I don dey steal my paddy money to buy iya basira rice.
Even on my girlfriend birthday when she dey wait make I take am to ocean view,
I no know when I pass the place, the only thing wey dey my mind na Iya basira palm oil stew
Ah! Kilon kilon shele shele me I never see this kind juju, telle telle
All those wey go vex kpele kpele, but I hear say Iya basira na.......
I sure say still I go go there go sidon, order my first round move
To 2nd round, 3rd round 4th round I no dey ever stop wetting iya basira come give me chop?
Repeat chorus.

Officer abeggi follow me to the palce, everybody don telli me I dey craze
My girlfriend don leave me my moda no gree see me my paddy ah! Iya basira e don kill me. (x2)
Oya people, people make una stop officer e don come
Where the woman, hin dey inside, (oga I dey come)
Woman na wetting you dey give people chop wey dey cause all this wahala casala, oya make we talk
Oga sir true to God, nothing wey I dey put for the food wey I dey cook, na God dey make am good.
Na which kind talk be that, say na God dey cook the food abi you think say I be fool no be juju you dey put,
Infact I dey suspect say na.... You wash put sote people dey queue come dey rush for your stew,
Well to confirm am bring am make I chop small. Give me fufu 90 naira plus that soup wey dey draw.
Chaii correct this food sweet no be small shey una no go vex if I still order for more.
Officer no worry na the food be this
Oya people, people make una go, case dismiss.

Repeat chorus 2 times.
×



Lyrics taken from /lyrics/s/styl_plus/iya_basira.html

  • Email
  • Correct
Submitted by lakesyde

Iya Basira meanings

Write about your feelings and thoughts about Iya Basira

Know what this song is about? Does it mean anything special hidden between the lines to you? Share your meaning with community, make it interesting and valuable. Make sure you've read our simple tips.
U
Min 50 words
Not bad
Good
Awesome!

Post meanings

U
Min 50 words
Not bad
Good
Awesome!

official video

0-9 A B C D E F G H I J K L M N O P Q R S T U V W X Y Z